One Ghanaian national Derrick Van Yeboah wey dey part of romance fraud gang don chop seven years (85 months) imprisonment for di US.
Dis dey come months afta e plead guilty to charges on 5 March 2026, afta dem extradite am to di US for 2025.
Derrick Van Yeboah tok say im dey guilty of one count of conspiracy to commit wire fraud bifor di US District Judge Arun Subramanian, wey bin jail am.
According to di US Attorney for Southern District of New York, Derrick Van Yeboah aka ‘Van’ dey part of “one international criminal network wey bin steal more than $100m from victims from romance scams and business email compromise.”
US authorities inside court documents confam say Derrick Yeboah dey part of di network wey base for Ghana wey commit plenty scam against pipo and businesses for di US.
“Many of di victims be vulnerable old men and women, wey dem tri k to believe say dem dey inside romantic relationship wit dem. Dem use fake IDs, wey dem deceive dia victims to send money.”
US Attorney office explain say “dem also trick businesses to send dem money; in total, dem bin tiff and launder more than $100m from dozens of victims, afta dem tiff di money, dem carry am to West Africa.”
Dem find Derrick Van Yeboah guilty say im personally do many of di scam by using fake IDs to enta relationship wit di victims – like for 2019 and 2020, im use dis IDs to scam one Ohio woman and anoda one for Delaware wey im force dem to transfer $4.2m to account wey belong to di scam network.
Source: BBC







Discussion about this post